Iya Basira

By Styl-plus

On Expressions

Thumbnail

This na one buka wey I dey like to go

The food sweet sote e go make your mind blow, day and night iya bas how she do am I no know

They think say na jazz, my broad no be so

Chorus:

People people make una come o

Iya basira e don jazz me o, ooo

Everybody helep save me o

I no dey sabi chop ati my moda or my girlfriends place

People People make una come o

Iya basira e go kill me o, ooo

Everybody helep save me o

I no dey sabi chop again my moda or my girlfriends food

Long throat na food go kill you-no be so, I say na food go kill you - oga mi no be so

Wettin dey be say e get one day wey I say I go play go see my paddy Sunday

Na so I reach there but Sunday e don high on beer luckily for me him junior broad eye e clear

He say make we stroll to the area, little did I knw that I was strolling to my burial

Right there were oshodi bus dey load was a little buka close to the mainroad

I laf when e pass the door, e tell me say hin name na Iya bas for short but I bow when e order

Iwesiatewa, ero mm purewater not even mineral. I come gree say I go manage to chop am

Before I realize I dey order 2nd round, 3rd round, 4th round, I never still stop

Wetting iya basira e give me chop?

Repeat chorus

Long throat, na food go kill you, na food go kill you

Oga mi, you think say na play when I say na the way wey I dey, e no day ok

Wetting be your own advice, I don dey steal my paddy money to buy iya basira rice

Even on my girlfriend birthday when she dey wait make I take am to ocean view

I no know when I pass the place, the only thing wey dey my mind na Iya basira palm oil stew

Ah! Kilon kilon shele shele me I never see this kind juju, telle telle

All those wey go vex kpele kpele, but I hear say Iya basira na.......

I sure say still I go go there go sidon, order my first round move

To 2nd round, 3rd round 4th round I no dey ever stop wetting iya basira come give me chop?

Repeat chorus

Officer abeggi follow me to the palce, everybody don telli me I dey craze

My girlfriend don leave me my moda no gree see me my paddy ah! Iya basira e don kill me. (x2)

Oya people, people make una stop officer e don come

Where the woman, hin dey inside, (oga I dey come)

Woman na wetting you dey give people chop wey dey cause all this wahala casala, oya make we talk

Oga sir true to God, nothing wey I dey put for the food wey I dey cook, na God dey make am good

Na which kind talk be that, say na God dey cook the food abi you think say I be fool no be juju you dey put

Infact I dey suspect say na.... You wash put sote people dey queue come dey rush for your stew

Well to confirm am bring am make I chop small. Give me fufu 90 naira plus that soup wey dey draw

Chaii correct this food sweet no be small shey una no go vex if I still order for more

Officer no worry na the food be this

Oya people, people make una go, case dismiss

Repeat chorus 2 times