Temporary Turn Permanent

By Sound Sultan

On Me, My Mouth & Eye

Thumbnail

[Baba Dee]

Temporary don turn to permanent

Our government come back again oh

Temporary don turn to permanent

Oya see them coming again oh

Temporary don turn to permanent

Our government come back again, eh eh

[Sound Sultan]

Them don manya

Na we dem dey point but na dem dey smoke gbana

I see road block every angle and corner

But when thief come, all of dem go dey kawa

See my future leaders dem dey lean like shawa

No light, no water, you dey read and shower

NEPA don change name still no power

Oya on gen making noise every hour

Go filling station, you go queue na yawa

Line up for hours, you go sweat you go tire

One time for my people wey die for the fire

When gbese see gbese dey go full kawa

Oya, black killers go dey meet like Osama

[Baba Dee]

Temporary don turn to permanent

Oya see them coming again oh

Temporary don turn to permanent

Our government coming again

[Sound Sultan]

I don manya

When black leader go dey lead like Obama

Dem want die there, they no even know karma

Now black people blow bomb like Osama

One time for the people wey die for twin tower

Poor man thief, dem go burn am with tyre

Rich man thief na for court you go tire

Magistrate get price, every seller get buyer

The truth don die, even lawyer self na liar

Working working working, one day you go retire

When you go back village you go turn to a farmer

What about the boys? All of them wan hammer

Them dey carry laptop and turn to scammer

The truth don die, even lawyer sef na liar