[Verse 1]

Mr. Worky-Worky

Don dey work for Naija reach 40 years

No go forget when this sun e go set o

Try to dey save, make you no go regret o

Mr. Superstar

You don dey drive every flashy car

No go forget when this sun e go set o, oh

Try to dey save make you no go regret o

Mrs. Campus Baby

You don dey follow rich man pikin waka


[Chorus]

Oga ju o

Lo jo to ru ba ro

Ma se gbagbe ojo toju awa o

Lo jo to ru ba ro

Ma se gbagbe ojo toju awa o

Awa se


[Verse 2]

Mr. Borrow-Borrow

Like to impress with him best friend moto

Molue bus, you for enter dey come o

Jam take thе car 'cause you use am dey form o

Omo ajе pako

Reach for school come dey farawe butter

No go forget say na money dem gather o

Omo oni yo, owo o ni garri together o

Mr. I-Pass-My-Neighbour

Ma lo para le re mi dile ba le ba


[Chorus]

Oga ju o

Lo jo to ru ba ro

Ma se gbagbe ojo toju awa o

Lo jo to ru ba ro

Ma se gbagbe ojo toju awa o

To ni awa se


[Bridge]

Back in the memories

When you been get money

Everybody go dey gbadun you,dey follow you

Like ant dey follow sugar o

But when your money go

Your friends go turn to foes

Nobody go dey there, only you go wet for inside rain

Person wey dey drink garri get plan o

Make you no dey underrate poor man o

Person wey dey drink garri get plan o

E dey plan, e get plan

E just dey plan, e get plan o

E dey plan, e get plan o

E just dey plan for that rainy day


[Chorus]

Lo jo to ru ba ro

Ma se gbagbe ojo toju awa o

Lo jo to ru ba ro

Ma se gbagbe ojo toju awa o

Lo jo to ru ba ro

Ma se gbagbe ojo toju awa o, eh

Lo jo to ru ba ro laye e

Ma lo gbagbe ojo toju awa o

Tori awa se