Mathematics

By Sound Sultan

Released on 2000

Thumbnail

[Intro]

All stand, greet

(Good morning sir!)

Good morning, you are welcome to Jagbajantis High School

My name is Sound Sultan your new mathematics teacher

By the way, do you understand pidgin English? (Yes sir!)

Okay, na wetin we go use henceforth

Okay, carry your biro, carry your paper, eh


[Verse 1]

People of this world them plenty (Ṣo ti gbó?)

Sins of these people many, so many (Ṣo ti gbó?)

Many times plenty, multiply am (Multiply am)

Many times plenty, multiply am (Multiply am)

Multiply am, the answer you get na wetin dey make poor man dey cry

The answer you get na wetin dey makе rich man dey mess and leadеrs dey lie

The answer you get na wetin dey make young boys and girls join bad gang

The answer you get na wetin dey make innocent man rot inside jail (Kere, kere)

And them no fit to grant bail (Kere, kere)

Oh oh oh


[Chorus]

Everybody, oya o join Jagbajantis, solve mathematics

Wey dey dabaru our continent

So, oyinbo say na BODMAS we go use take solve mathematics, so follow Jagbajantis

Oya carry biro

B for brotherhood (Love your neighbour as yourself, otan oh)

O for objectivity (Be objective gentlemen and ladies)

D for democracy, democracy (No matter how bad it is, e better military)

M for modification (Of our behaviour, let's turn to our saviour)

A, Accountability (If you been dey chop money, abegi take am easy)

S for solidarity (United we stand, divided o ma ṣe o)


[Verse 2]

We enter new millennium (Ṣo ti gbó?)

Nigerians like one-twenty million (Won po gan; Ṣo ti gbó?)

World population na six billion (Six billion) Divide that one by one-twenty million, altogether, oya (Altogether)

The answer you get na wetin dey make people dey ja commot for naija

The answer you get na wetin dey make people dey travel, by hook or by crook

The answer you get na wetin dey make people dey sleep for embassy for visa

The answer you get na wetin dey make people dey sell them property for ticket

Kere, Kere

And them go travel sibe sibe kere, kere

Oh oh, eh


[Chorus]

Everybody, oya o join Jagbajantis, solve mathematics

Wey dey dabaru our continent

So, oyinbo say na BODMAS we go use take solve mathematics, so follow Jagbajantis

Oya carry biro

B for brotherhood (Love your neighbour as yourself, otan oh)

O for objectivity (Be objective gentlemen and ladies)

D for democracy, democracy (No matter how bad it is, e better military)

M for modification (Of our behaviour, let’s turn to our saviour)

A, Accountability (If you been dey chop money, abegi take am easy)

S for solidarity (United we stand, divided o ma ṣe o)


[Verse 3]

You dey stay AJ city, eh (Ṣo ti gbó?)

And him dey stay VG city (Ṣo ti gbó?)

Find your level for AJ city (AJ city)

Na rich man corner be VG city (VG city)

Try add AJ and VG city, all together, oya (All together)

The answer you get na wetin dey make rich man oppress, na them suppress

The answer you get na wetin dey make poor man dey press, but then agress

The answer you get na wetin dey make poor man dey try to keep up with the joneses

The answer you get na wetin dey make poor man pikin dey try to prove for him mate (Kere, kere)

My pocket money don dey finish. Kere. Kere. Oh oh, eh


[Chorus]

Everybody oya o join Jagbajantis, solve mathematics wey dey dabaru our continent

So, oyinbo say na BODMAS we go use take, solve mathematics

So follow Jagbajantis oya carry biro


[Verse 4]

Situation in this nation disposition

Our condition unexplainable pain in our hearts not to mention

Brothers killing brothers for the wages adoration

Resolutions are made for all we've made we lack conviction

And perfection is the order as we keep seeking solutions

Only God can solve, this mathematical equation


[Outro]

Thanks for your contribution Now any more question? (No sir!)