BETTA

By Flash

Thumbnail

World wide in my country ..everybody know me well o !

No wannn !!

(See!)

Sometimes , Sometimes

The things I read online

E dey make me want to dey para o

How man go fit kpai another o

Africans we dey try..

And I know it's one step at time (but tell me)

How man dey go dey sweat find money o

When government dey ragabonmi o

See Felix..Ask Felix !!

Weting happen the last time wey we go chill o !!

Couple blocks away from where we live

As light e no dey we say make we go drink ooooo...

Be Like say cloth e don scarce

Cuz even thief sef don dey dress like police o !

If you ask Felix how the matter be

E go say my brother na GOD dey protect person oooh

Under the canopy x 2

The baba of security..

Hammer us security eh eh..

Under your canopy x 2

The baba of security..

Hammer us security eh eh ..