8K Views

Thumbnail

Paperboi

Abeg

But you know some kind times, when you go just dey

Dey reason some of your guys them

When be say you don lost from the struggle, you know

Some of your guys when dey locked up

When dey do maximum for reminder

They just dey make you dey wan feel some type of way

Yeah, feel at home no mean say you go enter kitchen

Go open pot, serve food, my brother listen

I no dey too smile, you suppose know the reason

Half my squad don kpoof, remaining dey prison

When we small, we no believe say e go hard like this

Person go broke sotey e no go fit high like this

You never chop, slippers don chop, head fry like this

Do what I gats do because I no fit die like this

But area get the way e be, unto police matter

So na sense na him we take dey carry things waka

Brand new iPhone x with second hand charger

Your babe wan buy, no fear, I no go too charge her

The last time when zone five burst enter jungle

Two seconds, them don wear us government bangle

According to them, all of us when sit down na thief

Drop bar, give their oga, na once na him them shift

Powered by Rubicon Project

'Cause at all, at all, e no be an option

’Cause at all, at all, e no be an option

As we dey work so, make the money for pile up

Bobo ball oh

Ojote remind us, say no be only we dey find money oh

As e dey be so, e no be a secret

Say everybody na victim

For the street, everybody na suspect

Omo, the matter is complex, very too complex

Blood stain my polo the day them shoot Kowo for mumu matter

We dey where we dey chop owo

They say he die person money unto transfer

The matter pain me die, because na mumu bar

For hundred dollar gift card, area fit shoot you

Run go hide, two seconds them don root you

If you no get money to pay or get collateral

My advice, stay away from transfer matter

I know boys for area when they no get joy

They no wan know who dey right, their own na destroy

They don clock 45, but dey their mama house

Na everyday their family dey go settle SARS

Girl cheat dey dey ask, what's the update

Make I update you, make your boyfriend fly my gate?

My area normally rough, forget baby

I dey with my pampers incase they wan come pay me

'Cause at all, at all, e no be an option

As we dey work so, make the money for pile up

Bobo ball oh

Ojote remind us, say no be only we dey find money oh

As e dey be so, e no be a secret

Say everybody na victim

For the street, everybody na suspect

Omo, the matter is complex, very too complex