I Dey

By DarcSlim

Released on September 18, 2023

Thumbnail

Intro:

Guy people dey go through alot o

(I swear down my guy)

You go just see person like this, e face dey normal, but people they go through...

(Deep down, if everybody start dey tell you wetin dey sup for their life ehn, but if you still ask them how far)

They go say fine

(They go say I dey)

(That thing just funny, e dey like default setting)

I swear... Omo guy

(If you call your guy now now, something fit dey do am but if you ask am how far, now now just call am, you go hear say, I dey)

Na so na, discussion no dey bring solution but wetin we go do, you go just answer them I'm fine, I'm finе

(Who wan help you, nobody my guy, I swear o, just bottle your shit up o, my guy)

[Vеrse 1]:

What is life for me?

Post NYSC, been submitting CVs

Data still chopping my money

My small 2k, 3k, wey I use dey see face

From this graphic design something

I dey find 9 to 5 but I despise working

Cos that shit go take my time

Time I fit use rhyme wordings

But I no get job, so no dey ask me what's up

[Bridge]:

Cos behind every I dey na person wey dey lie

How far, I'm fine, na person wey dey cry

Many people walking closets hiding shit with a smile

If you relate to a line, play this back one more time, bruh

And that ain't a chorus

Just want to get some shit out my mind

Till the music gets so big, it can actually pay my bills

I need to find money

Cos I no fit chop rhymes or I go die hungry

[Verse 2]:

Before now I didn't have music out on spotify or soundcloud

Artists pay for studio time while I record on bandlab

Beatstars I don't have cash to cop these beats

So I'm on youtube, searching free for profit beats

My bro called me, buddy, life is going roughly

I need sudden money, could you run it for me?

Then he told his story, I couldn't help but note

This the same dude who cracked all the jokes

Whenever we hung out, him and the folks

Bruh, he literally smiles the most

See if them no tell you, man you no go know

So this song's for the people going through the most

I don't know how big your problems are

But if you've looked up to the sky

And tried to blink multiple times

Just to stop them tears from falling down

Make you no worry now, you'll be fine

But I don't know about me, see

I swear to God I put my heart in this song

Can't even pray no more, I get distracted with thoughts

Been saying thank you Jesus for 45 seconds

Vain repetitions, switch it up, I worship you Lord

My mind's racing through a plan B

Grab my lappy, wey I been dey use for graphic

Do some magic, turn am to device for scamming

And if I catch that white man on IG

I'll make his money vanish

Cos na wetin belong to Caesar I dey come collect

My eyes don red, e be like na wall socket

And right now I fly pass elon musk rocket

I launch pad, drop token, you connect wallet

And I'ma, dip with your funds, no dey form rugged

Cos I'm the OGB, shey you wan collect?

But I left these thoughts at the chum bucket

And if them ask me how far

I go still tell them say I dey

Cos I dey

And fuck a plan B, I put it all on plan A

Plan A

Outro:

(Phone ringing)

Voice 1: Hello

Voice 2: Hello guy

Voice 1: Ayy big man, what's good?

Voice 2: How far na?

Voice 1: Omo I dey o, how your side how you na?