Collateral Damage

By Burna Boy

On African Giant

Released on July 26, 2019

75K Views

Thumbnail

[Chorus]

Oya dey there, oh

Ambassador go dey chop (Dey there, oh)

And Governor go dey chop (Dey there, oh)

And President go dey chop (Dey there, oh)

When dem say, "Make we jump", we go jump (Dey there, oh)

Ambassador go dey chop (Dey there, oh)

And President go dey chop (Dey there, oh)

And Governor go dey chop (Dey there, oh)

When dem say, "Make we jump", we go jump

[Verse 1]

No be for here wey dem born Jesus, ehee

My country problem e pass Jesus

Because na we be our own problem, ehee

Na who go come reason well? Well, well, well

[Chorus]

Oya dey there, oh

Ambassador go dey chop (Dey there, oh)

And Governor go dey chop (Dey there, oh)

And President go dey chop (Dey there, oh)

When dem say, "Make we jump", we go jump (Dey there, oh)

Some people go somersault

Dem get headache we go drink Panadol (Dey there, oh)

Meanwhile president go dey chop (Dey there, oh)

And Governor go dey chop (Dey there, oh)

[Verse 2]

Na who, na who dey here?

Money dey here

The thiefi-thiefi come major

Wey make the suffer come dey here?

Suffer yapa mukutun, brukutum

Wey dey make people sukun

Tukutum, won ni inu won o dun

Brukutum, suffer yapa mutukum

The people do you well-well

And dem dey laugh you well-well

And dem dey see as e dey shele

Them sef dey flenjo well-well

Yeah-yeah-yeah, oh, yeah-yeah, oh

My people suffer well-well

Police dey slap here well-well

Hungry dey wire dem well-well

Oluwa, Oluwa, Oluwa, Oluwa, Oluwa

[Chorus]

Oya dey there, oh

Ambassador go dey chop (Dey there, oh)

And Governor go dey chop (Dey there, oh)

And President go dey chop (Dey there, oh)

Dem dey say, "Make we jump", we go jump (Dey there, oh)

Some people go somersault (Dey there, oh)

Dem go dey get headache no go drink Panadol (Dey there, oh)

Meanwhile president go dey chop (Dey there, oh)

And Governor go dey chop

[Verse 3]

My people serve they fear too much

We fear the thing we no see

One day all of us go die

We always get reason to fear

Fight for your right, oh, you go dey fear

Police go slap you, you go dey fear

Fight for your pikin dem, you go dey fear

You go dey fear, fear, fear

[Chorus]

Oya dey there, oh

Ambassador go dey chop (Dey there, oh)

And Governor go dey chop (Dey there, oh)

And President go dey chop (Dey there, oh)

Dem dey say, "Make we jump", we go jump (Dey there, oh)

Some people go somersault (Dey there, oh)

Dem go dey get headache no go drink Panadol (Dey there, oh)

Meanwhile president go dey chop (Dey there, oh)

And Governor go dey chop (Oya, dey there, oh)

[Outro]

Dey there, oh

Dey there, oh

Dey there, oh

Dey there, oh

Dey there, oh

Dey there, oh