Illusion

By Brymo

Released on May 27, 2022

Thumbnail

You carry Boyi go yonder

You say he no go go oh

Slavers boku round town him brother tell am oh

Stand for your ground

Make you no hurry follow go

Them dey sell people troway

My brother no go oh

The people them wey go river them never return oh

Them say na mami water carry everybody go oh

For full moon, papa go farm he never return oh

Them say na the forest carry am swallow oh

Listen Boyi

Life no balance at all oh

You go place you no know

You no go return oh

Boyi feeling true

Him heart dey beat for the road oh

Him fate na to follow them

Follow journey go

Ah ah ah ah ah

Wetin I think I become ah

Ah ah ah ah ah

Na illusion them dey sell you so

Boyi look forth, him look out, no other place to go oh

He carry him few belongings, reluctantly follow go

For this life we dey, the things you do you know oh

E better to go reach the place find how e dey oh

I talk am, I shout am, Boyi still dey travel go

Na destiny dey push man where him dey go ah

He try am, he fight am, urge strong no be small

The tori e dey the place where him dey go ah

Ah ah ah ah ah ah

Na wetin I think I become

Ah ah ah ah ah

Na illusion dem dey promise you so ah

Hmmn hmmmn hmmn

Oga master no wan know value pig fat pass people oh

He say dem be property with him dog dem equal oh

Boyi clean gun, he shave beard

Oga trust no other

He for adopt Boyi, but him people go hala

That night Boyi take razor he shave am proper The way Oga dey like am

No touch him moustache ah

Poison for soup

For family and the guys them

He slash master throat too from ear to ear ah

Ah ah ah ah ah

Boyi na most wanted for strange country ah

Ah ah ah ah ah

He dey gather soldiers ah

From plantations he dey break boys free ah

(Clears throat)

Ehn ehn

My people

The main reason we gather here today, na him concern us now

Na there we dey go next

Ah today on behalf of the people of the city and the township, the entire tribe and our very very race, we go unveil this statue of boyi

We go give our honorable personality himself the scissors to use cut the ribbon

For service to humanity and to race and eh we salute you sir

We salute you well well, because you really touch our lives, you don change our lives from generation to generation to come

Nothing go ever remain the same for us

Yes, this statue na the honor of your greatness

Thank you