Disrupt The Programme

By BANTU (Crew)

On Everybody Get Agenda

Released on April 10, 2020

Thumbnail

[Intro- crowd chant]

Freedom, freedom, freedom.....


[Chorus]

We must to disrupt the programme

Put sand sand for their gari

Regain our freedom by any means necessary

Disrupt the programme

Put sand sand for their gari

Regain our freedom by any means necessary


[Verse 1]

Oga no tell me say make I hold my anger

Make I no make noise make I cooli temper

When herdsmen dey slaughter, massacre we brother

From Benue, Ekiti, Enugu, Zamfara

Hundreds dey die dey peme like fly

Blood e dey flow government dey turn eye

Silent indifference dem go play with our sense

Point hand for Libya to bury di matter


[Chorus]

We must to disrupt the programme

Put sand sand for their gari

Regain our freedom by any means necessary

Disrupt the programme

Put sand sand for their gari

Regain our freedom by any means necessary


[Verse 2]

How long we go dey wait dey sit down debate

Dey waste our saliva dey yan for social media

Nothing go change if we no organise

Call out their bullshit and cut them to size

Na we get di strength na we get di numbers

Nothing to fear my brother rise up my sisters

By vote or by force we must wipe di slate clean

This yẹ́yẹ́ politirikshians must enter dustbin


[Chorus]

We must to disrupt the programme

Put sand sand for their gari

Regain our freedom by any means necessary

Disrupt the programme

Put sand sand for their gari

Regain our freedom by any means necessary


[Bridge]

Freedom – The clock is ticking

Freedom – It’s all or nothing

Freedom – Don’t come for begging

Freedom – Stand for something

Freedom – It’s all or nothing

Freedom – The clock is ticking

Freedom – We done with talking

Freedom – Just stand for something