I dey my own for class jegeli

This agbaya enter class

And him built heavily

Definitely, ehn

This guy grab men, no doubt

When he pull shirt na so the whole class just shout

Yeb, yeba, yeba

Some use window cut out

Even my teacher respect em self

Just close mouth

The bobo come short well well like small stout

With characteristics of a well brought up Lagos tout

I no dey owe the guy but my guy tight sha

My men dey tell me otherwise

2shotz you no go ja

My pastor say

My son thou shall not fear

When hot piss fill my bladder as my guy near

Boy you no dey yan where I dey

Misbehave where I dey

But now you don dey pull grounds this years wey I dey

See this small boy sef

Rant with you no go tey

Na one blow, you going straight

Wey you die, you don ah

You think say na the gym wey you dey gym

Be your advantage

You never hear of small boy lepa wey dey rampage

My guy cool down

You never hear of David and goliath

The ant and the elephant

Make we no go into that

Some people get their power for different settings

Some na from their big mouth

Dem dey use run things

Some things dey wey we no suppose do brag for

So therefore behave yourself

Wagbon

Bia nwoke iche ni siri ike

Odeshi

My guy you think say you strong

Odeshi

Nanya take your time

Mind yourself, one blow

And your blood go dey flow

Odeshi

Bia nwoke iche ni siri ike

Odeshi

My guy you think say you strong

Odeshi

Nanya take your time

Mind yourself, one blow

And your blood go dey flow

When man fall down

No be the end of en life

Eh stand well well when person won chook you knife

Ah ah, I look left, I look right

My liver fail me

Na only me dey here

And I fit loose this fight

You won try me ehn

You won try your father

Today I go show you say khaki no be leather

The guy hold me for throat

Hold me for trouser

I begin beg for Yoruba, and igbo and hausa

The sweat wey I sweat fit full one bucket

My eyes don red nearly fall from en socket

Pow, one for head

Pow, one for chest

See me wey dey talk dey fall

My liver rest

People wey dey pass come dey help me beg the guy

Dem be just dey gather

See en blow one for eye

Everybody clear

Leave us for there

Oh boy you’re on your own oh

Ah ah this is not fair

Na my phone don miss

And I dey very piss

I look at this guy ah ah

What the hell is this

I give am blow for face

But en still hold my waist

This guy too strong but en no get crase

I look round, around

I see sand for ground

I took me a hand full

And threw it at his face

Yay my eye, yay my eye

If I cath you my guy you don die

Catch who, catch who

Shey na me, shey na me

You don gock am, you don gock am

Terribly

As I see say the sight don dey briefly impaired

I break bottle for en head

Bia nwoke iche ni siri ike

Odeshi

My guy you think say you strong

Odeshi

Nanya take your time

Mind yourself, one blow

And your blood go dey flow

Odeshi

Bia nwoke iche ni siri ike

Odeshi

My guy you think say you strong

Odeshi

Nanya take your time

Mind yourself, one blow

And your blood go dey flow

Odeshi

Anyi abiala bia k’anyi gawa

Eh 2shotz umuunnamo (4x)