[Intro: 2Baba]
Oh-oh
Alright, yeah
Yeah-yeah
Hear word
Ploops productions
[Verse 1: 2Baba]
Help me spread this message like Globacom
Make nobody come here dey come dey form
I know say no be everybody follow come
And no be every breast wey be silicon, ehen
Make dem no come dey wash you
And make you do exactly what you wan do
Make you no say I no tell you
Make you no let devil come dey use you, ehen
[Pre-Chorus: 2Baba]
But if I tell you say I love you
Abeg, abeg, no go turn me to your mugu
That time, 30 billion no go do you
That time, Edumoga no go see you, ehen
And if I start to dey stress you
Let me know because I no want to vex you
Bottom line, na only you wey know you
The same time you go do wetin wey favour you
[Chorus: 2Baba]
Ah-ah, eh-eh, oyi, alo ma yego ligbo
So make we do the thing jeje, make we do the live show
(Do the thing jeje, do the thing jeje)
Eh-ah, eh-eh, oyi, alo ma yo otukpo
So just be living your life and do the thing jeje live show
(Do the thing jeje)
[Verse 2: 2Baba]
If body dey hot you, drink water
No come, come dey form like butter
Because I know say you know say I know you
And no be every dressing go fit you, ehen
Make you no make me mara eh
Attentiveness for my matter eh
I no fit halla, I no fit shout
I no wan make na me and you dem talk about
[Pre-Chorus: 2Baba]
And if I tell you say I like you
Abeg no let shakara come dey kill you
That time, 30 billion no go do you
That time, Edumoga no go see you, ehen
And if I start to dey stress you
Let me know because I no want to vex you
Bottom line, na only you wey know you
The same time you go do wetin wey favour you
[Chorus: 2Baba]
Ah-ah, eh-eh, oyi, alo ma yego ligbo
So make we do the thing jeje, make we do the live show
(Do the thing jeje, do the thing jeje)
Eh-ah, eh-eh, oyi, alo ma yo otukpo
So just be living your life and do the thing jeje live show
(Do the thing jeje)
Ah-ah, eh-eh, oyi, alo ma yego ligbo
So make we do the thing jeje, make we do the live show
(Do the thing jeje, do the thing jeje)
Eh-ah, eh-eh, oyi, alo ma yo otukpo
So just be living your life and do the thing jeje live show
(Do the thing jeje)
[Verse 3: HI-Idibia]
Make you dey check yourself
Before you come dey do wetin go cast you
'Cause I don try for your matter
Make you butter, make you no dey do pass you, ehn-ehn
'Cause I go do my own and you go do your own
Anything wey remain, na bone we go bone
'Cause life is too short for debating
Levels too pure for you, na wetin?
[Chorus: 2Baba]
Ah-ah, eh-eh, oyi, alo ma yego ligbo
So make we do the thing jeje, make we do the live show
(Do the thing jeje, do the thing jeje)
Eh-ah, eh-eh, oyi, alo ma yo otukpo (Oh-ai, yeah)
So just be living your life and do the thing jeje live show
(Do the thing jeje)
Live show, live show
[Outro]
Mixing Zeeno Foster